Eyinn people, werrin dey?? hope no 'wahala'. but wait o!! una see yesterday's 'hold-up'? Mehn....dat one don pass traffic o, i actually wished i could fly home.*grins* but what'a gwan with lagos n traffic sef or e get where dem dey 'dash' people motor??? cos everyday na so cars dey 'boku' for road; if so make i go collect two 'tear-nylon' o, one 4 my sef and one 4 my Granny; at least i wld be happier knowing she now goes to the farm with her RAV4 or CRV, lol hard to imagine shey?? Gran-momsy behind the steering with hoe/cutlass/basket on the passenger's seat LMAO. But seriously, i wonder how pple'll cope when the FG closes 3rd mainland bridge (for repairs) on saturday, i sure say pple go dey enter canoe go work (nor be laffing marrer o) but come to think of it,its another way of making money o, i only need to buy plenty 'canoe' from 'oworonshoki', hire some drivers/divers with one or two life jackets (i cant shout) and charge passengers like 200 bucks per trip ( e nor cost o, remember say i go settle 'agbero' plus no go-slow), LG canoe transport services ltd don 'set' be dat :) or how una see the idea?? all the investment /financial experts in the house, holla!! :-)
(i digress) Yesterday's traffic was terribly o, d annoying thing is dat u can neva tell wats causing it n today doesnt look any different, dis lagos sef!! *hiss newayz' as i alighted at my bus-stop, alarm begin tear me' i then remembered there was no food in the house, so i strolled to the ms. small (no free advert) close by to get 'beans n dodo' (one my favourite) after getting my food i decided to eat it there (free A/C plus Dstv) i had taken like 5 spoonful then heard clank! clank! clank! i looked up and saw a babe seated adjacent me, eating meatpie wit cutlery; Now i have a problem' n dat problem is dat 'i sabi laff', i nor mind where i dey o, as far as i see sumthing wey funny, hehehehehe go jus come out; so when i see dis mgbeke feeling funky dey battle meatpie n fork, my hehehehe change to hohohoho :-) i cldnt control it o, ofcourse the babe knew why i was laffing, cos she gave me one wicked bad eye, then resumed the WWF, una need to c her face as the fork nor gree co-operate with the knife :-) for my mind 'make dis girl nor chook/cut hersef o, abi na by force?? even the (fine sistah, anything for d boyz) security guards noticed it and were giggling but d babe no send us, IF nor be say i too love 'my face' i for 'snap' her when she dey chop and upload am 4 una :-) but WHY babes like to 'form'?????? (me i no go lie' i used to form till i disgrace mysef n even got a nickname Bouncing Okpa, lollll i ll tell u guys abt it ONLY if u promise not to laff. *grins* but una neva my question o, i say why 'some' babes too dey 'form'???????
UPNEXT: MY HAIRDRESSER 2 (THE REVELATION) **STAY TUNED!!!!**