Wednesday, July 2, 2008

I dey feel like....

Awon temi, na jeje i dey for my corner o, dey mind my business wey dis 4 musketeers: prisco , ibiluv, tairebabs and buttercup gang up to TAG ME, upon say i get exemption leta from tagging :-) newayz, since its has to do wit music and my oga don comot, make i do now.

The rules:
1. Put Your iTunes/ Music player on Shuffle
2. For each question, press the next button to get your answer
3. YOU MUST WRITE THE SONG NAME DOWN NO MATTER WHAT
4. After you’ve answered all of the questions, tag 5 other people and then let them know (hehehehe, dis I like)

So here goes:
*IF SOMEONE SAYS “IS THIS OKAY” YOU SAY?
Dem mama-timaya
una dey c temptation???? lollll

*WHAT WOULD BEST DESCRIBE YOUR PERSONALITY?
Fefenefe- Tony teuila ft Tic-tac
aaah!! which kind fefenefe ?? tic-tac, come o i hear say u don relocate to 9ja now, oya come xplain o, loll

*WHAT DO YOU LIKE IN A GUY/GIRL?
True love- Tuface
need i say more????

*HOW DO YOU FEEL TODAY?
Close to u- Wande coal ft Dbanj

yess, i nor go lie, i need to be close to - (name withheld) n i dont mind small koboko too, lolllll

*WHAT IS YOUR LIFE’S PURPOSE?
No one knos 2mrw-Asa

LMAO haba!!! but no body kno's 2mrw shey????

*WHAT IS YOUR MOTTO?
Let dem say-Nomoreloss

Shege -jaguar!!!!, how dis thing take kno, lolllll

*WHAT DO YOUR FRIENDS THINK OF YOU?
Koleyewon- Eedirs abdulkarem
yesso o, pam pam ti pam pam pam-pamm!! Koleye iwo' nor, lol

*WHAT DO YOU THINK OF YOUR PARENTS?
Sho like 'e- Jazzman olofin
LMAO!! b4 nko

*WHAT DO YOU THINK ABOUT VERY OFTEN?
Ogologoma- Timaya
ohhh!! dis one dey 'tortorri' me for bodi, nothing beats it, i tell u.

*WHAT IS 2+2?
Right here- Tuface
ehen now, abi werrin una tink???

*WHAT DO YOU THINK OF YOUR BEST FRIEND?
Jailer- Asa
huh?????

*WHAT DO YOU THINK OF THE PERSON YOU LIKE?
U r still d one- Sunny neji
Ok na!!! Shebi una kno unaa sef .

*WHAT IS YOUR LIFE STORY?
Adara- Sasha

*sings* Hey, keep
ur head up dont u cry!! U can make it if u try!!, .........(chop mouth)....... ADARA, lollll

*WHAT DO YOU WANT TO BE WHEN YOU GROW UP?
Loke – Dbanj

Nuf 'said,

*WHAT DO YOU THINK WHEN YOU SEE THE PERSON YOU LIKE?
Malaria- soty
Dis one pass me o, lol

*WHAT DO YOUR PARENTS THINK OF YOU?
Say u believe me- plantation boyz

hehehehe, i believe una na but not everytime o, esp wen una say 'no money' *wide grin*

*WHAT WILL YOU DANCE TO AT YOUR WEDDING?
Roll it- Psquare

yess o, i go soooooo roll am ehn, lollll

*WHAT WILL THEY PLAY AT YOUR FUNERAL?
Adupe- Tunde & Wunmi Obe

I cast, i bind, i reject, i scata...., how can they be singing 'baba ti'se se o, at my funeral, ???dem nor go cryyyyyyyyyy?????

*WHAT IS YOUR HOBBY/INTEREST?
I no want trouble- Stylplus

hehehehehehehe, dis is wat i always say wen i see person wey fit beat me, lollllll

*WHAT IS YOUR BIGGEST SECRET?
Loving you everday- faze

Ok, i confess, i confess dat ... dat..... i luv 'peeto',.

*WHAT DO YOU THINK OF YOUR FRIENDS?
You need somebody- faze
sooooo on point guys, u need someone like me, yeah me...., lolllll

Finally
*WHAT SHOULD YOU POST THIS AS?
I dey feel like- tuface
yessssso i dey feel like........ like...... abeg, werrin i dey feel like sef, lollll
NOW it gives me great pleasure to tag: Scofield/molly lolll i meant
Standtall, Chi-grace, Aphrodite, Ajike n Ejura. No excuses peeps, lolllll

62 comments:

Afrobabe said...

1ssstttttttttttttttttttt

Afrobabe said...

kai I too much...lmao...

Afrobabe said...

ur best friend is a jailer??? Run for your life babes...

LG said...

aproko-afro who call u?????
i neva even edit finish, oya go n come back, lollllllll

Flourishing Florida said...

u have d nicest collection of naija music!!!!!! & most od dem come match! come o, wetin wrong with Adupe 4 ur funeral. Adupe no mean, we thank God. look am dis way na, u don old sotey, dem don dey wait 4 u 2 die since since!!!! na y dem dey thank God

Thirty + said...

Why are you all binding casting - lol. Maybe that is what they will sifn when you are very old and grey and they are happy that you have gone to rest :).

Anonymous said...

LMAO!!!Babe dont kill me with laughter o. I see your love for Nigerian music is on a kentro level!

LG said...

FFE,: leave am for me, i say i no like dat song, abi na by force??? inshort if dem mistakenly play am eeh, i go resurrect o, lollll

LG said...

30+: iwo nor',
eeh, eeh, una dey find my trouble o
i say i no want dat song CHIMPLE, lolllllll

LG said...

MINKY: thanks swerry..,
oya na, kamakazeee, lollll

AJIKE said...

buhahahahhha
lg don come again o
they would sing baba ti se o on ure funeral...skeen skeen skeen...
ure best friend is a jailer?....lol
ok..
meanwhile i love ure music combo mehn
feeling u seriously, me self i like them jare...
hmm so i was tagged again, minky tagged me b4 o,
omo i was like long
ild think about it again sha!!!
eeeeeh, so i am no 11
ohohohohohohoho
wetin self
person no fit be first for this place
lg, u r a celeb ooooooooooooooooo!

darkelcee said...

lolll

ur songs are somin else

ur personality is Fefenefe? what's dat? loll

Allied said...

i seriously need to get Naija music oh... LG, come, tell me what the good songs are jare

i am having a party soon. PLEASE

Jennifer A. said...

Oooooohhhh...you got bitten by the bug...

Tairebabs said...

It's official, whoever invented this musical tag came up with a good idea. I love reading it as I get a sense of the type of music pple enjoy.

The funeral question was too funny o. like free-flowing florida and +30 said, old age was in mind.

Mz. Dee said...

Babe... u sure say no be jazz u use 4 this ipod???
Ur own was just performin wonderful signs and wonders 4 u!!
U lucky too much jare.. :p

Mz. Dee said...

oo btw.. i luv LOVE LOVEEEEEEE ur music taste!

bumight said...

u seem to be sold exclsusiveely to naija music.

maybe they'll play "Adupe" at ur funeral, cos they're happy u're gone? lol *running for my life!*

LG said...

AJIKE: yaaaaaaaay,i made u laff but wait o, werin dey do all of una wit d funeral song sef????????

DARKELCEE:babes, i don dey try tic-tac no. since yestaday, e nor dey go tru, cos na only him fit answer dat question o, lolllll

ALLIED: not problems swerry, how do u want it??

JAYCEE:Aaah my 6tar, no be just bug o, na bug+s+s+s+s lollllll

LG said...

TAIREBABS: babez, u nor lie, i actually njoyed doing dis, wish i can do it again, lolll.....

MZ.DEE: swerry, na u talk am o,hehehehehehe n thanks, i love
9ja music too mush

BUMIGHT:*LG singing* U can run, u can hide but u cant escape my CANE,
lolllllll

Duchess said...

*panting*..........oooohoohh...thoti wuld be first...after running 5000mtrs race....i din even make top ten...babes dey try ring me as soon as u update na.

oti sese o ...o ti sese o ...o ti sese ooo
ADUPE!!!!

lol....they are going to sing that on ur burial.
this tag na devil sef.....LoLlllls

LG said...

*fuming* If i hear one more word abt dat song AGAIN, something go SHELE for blogville o!!
Duchess , oya bring ur ear come make i reward u 4 running 5000mtrs
*hiss*

ibiluv said...

ur tag...i love i love.......

when u don turn 120 dey shrink for bed....dem dey turn you,make your skin no comot for bed.......

when u die na ADUPE dem go sing...damask dem go take bury you not ankara..........lol

babes...all u need from baba loke is a good life......long life and plenty property....

love u babes......

LG said...

ib, ib, ib
how many times i shout ur name?????
eeeh, if nor be for d praya wey u pray for me , i for...i for.......
newyaz AMEN to d praya, i need am jare, lolllllll

SOLOMONSYDELLE said...

lol @ what you think of your friend aka Jailer. Too funny.

How body?

NIGERIAN CURIOSITY
IT WAS SO MUCH EASIER WHEN I ONLY HAD ONE...

LG said...

MummyTK so na only dat one U and AFRO see abi??? newayz no wahala cos una two na my friend , n dat makes u both JAILERS, lolllllll

howz my boi,TK??

Jinta said...

"WHAT WILL THEY PLAY AT YOUR FUNERAL?
Adupe- Tunde & Wunmi Obe"

no further comment. lmao!!

LG said...

No, u for comment na, abi ur keyboard fail u????
yeye,i have a mind to delete dat song NOW!!, lollll

Unknown said...

This your playlist random shuffle na wa o. I just dey speechless sha. How u dey?

Lol @ aproko-afro wey come when u neva edit finish. Furrrrssstttt na hard work!

LG said...

NAIJALINES: my 6stah, HELEP me ask Afro o,
i neva confirm d post sef, she don read am finish, drop comment,
dat babe fast nor be small,lollllll

Mommy said...

hmmm...at least your responses are sane. How you dey na?

FineBoy Agbero said...

hahahahahah!!!!
Pele, but i gat mention dat funeral song!!!

*WHAT WILL THEY PLAY AT YOUR FUNERAL?
Adupe- Tunde & Wunmi Obe


Now see it dis way: dem go sing Adupe 4 a lyf well-spent, abi?

LG said...

MOMMY: Ese o *kneels* mo wa pa'
nor mind some pple *points at ---*
dem kno demselves ni'

FINEBOY AGBERO: bros,if no be say i dey gbadun ur gist, i for no gree o .....
ok, ok, i accept,make dem play ADUPE for a life WELL SPENT- AMEN
*widest griiiiiiin*

Nigerian Drama Queen said...

I like the song you will dance to at your wedding!

musco said...

hey,u shld be my best friend.we seem to have d same craze 4 naija music.i appreciate ur selection of naija music.

u shld listen to 'wedding day' by 9ice.u cld ve a change of heart abt d wedding song.

Parakeet said...

Na only nija songs u dey listen to? Looks like this songs get eyes oh...some of them are so spot on.

Sasuke said...

meeen! this thing wey una de do for blogville now dey fear me because the kind playlist wey i get no be the better ones.

come na only nija music you dey listen to self?

isha said...

LMAO!!! Na wa o, this thing is quite scary o. Almost accurate sef, at least in most cases. I'm liking your play list in general o.

Edirin said...

nice one and very interesting...this tag thing they tag me, i do am...i con lost the paper whey i type am put..since them the thing just tire me

Anonymous said...

Seems afrobabe like to be first at this.....cute



But just go along with the game, seems fun.

Have a nice one

Manda said...

babes i sooo luv dis ur post.. person wey come up wit this whole music thingy try o!

make ur folks see dat mo like e 1st!

Ms. emmotions said...

lol@ florida...u ve lost it o, no be only adupe ...na adupe o...lol

so LG, me i no envy you guys with this tag thing o

IT'S JUST LIFE said...

Truely 9jn, LOL!!!!! I like ur mix.

LG said...

NDQ: thanks correct babe, d rolling nor go be small thing, loll

MUSCO: ehn, i neva hear am o, hope say nor be yoruba him use sing am sha!!, lolll

PARAKEET: babes, no wahala, i go do the part2 with westerns songs
4rm my WMP, just for u o.

SASUKE: k, playlist of western jamz coming up soooooonest, lolll

Chari said...

Ahemm...I know say 9ja girls like Koboko na...I have one size opf koboko for here...u wan try?...your life will never be the same AGAIN!

Lailai! I no go gree LG this playlist was skewed!!! Lailai mi o gba!

so u will be dancing to roll it at ur wedding abi? well me sef I go rock ur yansh one last time b4...ehn...but I go like wear ma running shoes first na...

Chari said...

FENEFE is Asante for BREAST!!!


so ur a breast! buahahahahahahahah!

LG said...

ISHA:thanks dear, me too dey suspect am, lolllll

FRESH N FAB: ahh pele o,but u can do it again na,PLZ

KIN'SHAR:thanks hon,pay no mind to AFRO, U too can be first. lollll

MANDA: lolllll, mo like e nor'
I hear say u dey do parry,hope say d cake neva finish????? lol

LG said...

MS.EMMOTIONS: babes, no mind her jare, ise' nko???

SOMEONE ELSE'S LIFE:thanks,9ja for life, hope u r gud???

CHARIZIARD:lolllll don chari,take ur time o, take ur time na WHO BE BREAST???? shebi u wan rock nyash, oya come wit ur koboko, i dey wait with ACID,lolllll *hiss*

BTW u said d playlist was skewed, tell me, y wont it be skewed, wen they r going to play ADUPE at my funeral, tell me. lolllll

The Activist said...

You this lady. Wetin I do o. Why you go tag me? You for tag Socfield, Molly and Garfield jeje. They would have answered gladly. My birthday is 13th of July a day b4 yours and I am meeting 2 bloggers on that day. One is Charizard, we are meeting for he love of cats (lol). I don’t know who the second person will be. May be you, if you won’t jump out of my house when you see the cats. LMAO-ROFL

(I have been trying to post this since 3 days ago)

LG said...

yaaaaaaaay, i knew there was a sumn abt u, *does makosa dance*
so we r baffday pallies somehow abi?? bcos wen dem chop ur rice finish, dem go come chop my own,lollll
chei, *scratches head* i wld have luved to come, but i no wan DISGRACE mysef *i kid u not* newayz i'm thinkin of sumn else sha'

BTW,ahhhh u ve been tryin to post d comment for 3days,
shege-blogger,lollllllll

ejura said...

This tag just the follow me. Princesa tagged me and I gave one excuse and now you are saying no excuses. I'm ashamed to put up the kind of music I listen to. Even my mom who is old school in that regard calls me old school. Oh pls don't make me do this tag or I'd just end up shuffling songs in my head and putting them up.

What say you LG? How body?

Dee said...

You are indeed a true Naija Babe who loves Naija music! Keep on rocking jo!

LG said...

EJURA:awwww babes,why na??? OK i wan to hear d playlist in ur head, its even creative sef.
lolllll @ old skool, warever, i just want to hear it.

DEE:Thanks swerry, we'll surely get there!!!!
howz d fam?

princesa said...

LG, u be real naija patriot o!
Nothin do u my sista.

Go on soun....!

Meanwhile u no reply my mail o

Naija Idol said...

waaat??no 54. i nor try. anyways. its my first time here, so how we wan take wash am now???.lol.

LG said...

PRISCO: lolllll thanks hun,
i dey go reply sharp sharp, lolll

NAIJA IDOL: *opens door* oya come in, ehen siddon for dat chair, yes, dat one; thankyou, wetin i go offer u now, *scratches head*
my sistah, u come late o, i neva cook and 'Iyabasira' don sell finish, na only 'zobo' i get; shebi u sabi zobo, aaah omodada, u go like am, e go for finegals like u, wait make i go bring am.
(LG don dey kolo o) lollllllllll

Welcome swerry,hope u ll be back??
Cheers!!!

BlogVille Idol said...

RUN RUN OVER TO BLOGVILLE IDOL PAGE THE CONTESTANTS HAVE THEIR 1st SONGS UP SO PLEASE LISTEN AND VOTE FOR YUR FAVORITE AND PLS LEAVE US A KIND COMMENT!

NikkiSab said...

I love d music line up gal!!!!!av a nice week

Lighty 'neferet' Kopearl said...

well in the spirit of all of this, let lighty be the one on ur vote for blogville idol 2008. thx

Sugabelly said...

Hey, saw your comment on Sha's blog!! Thank you for appreciating my t-shirts!! Just wanted to let you know that we've got our own domain now: http://www.barcelagos.com, and that if you'd like to order a t-shirt, or have a custom t-shirt/polo specially made for you (I once did one for a client with his face on it, it looked amazing), just stop by my blog http://sugabelly.blogspot.com or send me an email at barcelagos@gmail.com!

Loving your blog!!

simplegal said...

lg I'm loving you music collection oh! You have to hook me up oh...

Buttercup said...

hahahahahahaha!

lol @ ur best friend being a jailer n u choppin ur mouth for 'adara'..hahaha!